-
Zechariah Chapter 5
Di Vision Of Di Book Wey Dey Fly Di Vision of Di Woman Wey Dey For Inside Basket 5. Naso di angel wey dey follow me tok—con come front, and he tell me sey, “Look up make you see wetin dis tin be—wey dey show-face.” 6. So I ask am sey, “Wetin e be?” He con ansa me, “Na basket for measuring seeds.” He con still tok sey, “Na dis be di sins of di pipo for di whole land. 7. Naso dem carry di cover of di basket wey be lead, and one woman sidon for inside di basket”; 8. He tok sey, “Dis na wickedness,” and he push…
-
Zechariah Chapter 6
Di Vision of Four Horse-moto Crown For Joshua 9. Baba-God message come meet me, sey: 10. “Take silver plus gold from di pipo wey dem carry as prisoners go Babylon, but wey just come back from Babylon; Heldai, Tobijah, and Jedaiah; con go Josiah house—wey be di son of Zephaniah, on di same day. 11. Take silver plus gold, make crowns, con wear am put for di head of Joshua wey be di son of Josedech, di high priest; 12. Tell am sey, ‘Dis na wetin Baba-God Almighty dey tok: “See [watch out], one man wey hin name na DI BRANCH; and he go grow out from hin place,…