-
Malachi Chapter 1
Baba-God Love Israel Offerings Wey No Good 6. “Son dey honor hin papa and servant dey respcet hin oga. If I be papa, where my respect? If I be your Oga, where di respect wey una suppose give me?” na wetin dey Almighty dey ask una, “Chai priests, na una dey use my name play.” But una go ask sey, ‘How we take use your name play?’ 7. “Una dey put food wey no clean for di altar. But una dey ask, ‘How we take downgrade your name?’ “Una downgrade my name wen una tok sey Baba-God altar no need respect. 8. Wen una dey bring animal wey don…
-
Malachi Chapter 2
Warning To Priests Judah No Dey Faithful 10. Abi no be one papa all of us get? Abi no be one God nahin make us? Why all of us con dey betray awa brodas, by breaking di agreement wey Baba-God make wit awa papa-papa-papa? 11. Judah don break dia faith. Israel don do mumu tin, and dem don do mumu tin for inside Jerusalem sef. Judah don downgrade di holiness of Baba-God love, by marrying di daughter of foreign god. 12. As for di man wey do dis tin, whoever di pesin be, make Baba-God cut am komot from di house of Jacob—even though he carry offering come meet Baba-God…