-
Mark Chapter 13
Sign Sey Time Don Dey End No-pesin Know Di Day Or Di Hour 32. “No-pesin know di day or hour, even di angels for heaven no know, or even di Son, na only di Fada know. 33. Shine your eyes! Dey watch! Una no know wen dat time go reach. 34. Wen Man-pikin go come, e go be like man wey wan travel far-far—wey komot from house, and he put hin servants in charge, con give dem dia work wey dem go do. He con tell di gateman to dey watch until he come back. 35. “So make una dey watch becos, una no know wen di owner of di…
-
Mark Chapter 14
Dem Anoint Jesus For Bethany Evening Food Wey Jesus Chop 12. For di first day for di Festival of Bread wit no Yeast, wey dem dey sacrifice di lamb, Jesus disciples con ask am, “Where you wan make we go arrange for you to chop di Passover?” 13. So he send two of hin disciples, he tell dem sey, “Make una go Galilee, una go meet one man wey dey carry container of water. Make una follow am. 14. Tell di owner of di house wey he enta sey, ‘Di teacher dey ask: Where di visitors room, wey I fit chop di Passover wit my disciples?’ 15. He go show…