-
Mark Chapter 15
Jesus For Pilate Front Di Sojas Dey Yab Jesus 16. Di sojas carry Jesus go di palace (wey be di headquarters of di govnor), con call all di sojas. 17. Dem wear am one purple cloth, dem use shuku-shuku make crown for am, con put am for hin head. 18. Dem con dey hail am, “Tuale, King of di Jews!” 19. Dem use stick nack hin head plenty times, con dey spit for hin body. Naso dem dey kneel down dey pretend to worship am. 20. Wen dem don yab am finish, dem komot di purple cloth wey dem wear for hin body, con wear am back hin own cloth.…
-
Mark Chapter 16
As He Take Raise Up From Di Dead