-
John Chapter 7
Jesus Teach For Di Festival Of Tabernacles Jesus Teach For Inside Di Worship-place 10. But afta hin brodas don go di Festival, he go there codedly sef. 11. Di Jew con dey fyne Jesus for di Festival, dem con dey ask, “Where dat man dey?” 12. Gist about Jesus con dey flow among di plenty pipo. Some of dem tok sey, “He be good man.” Some odas tok sey, “He no be good man, he dey play pipo wayo.” 13. But no-pesin fit tok about am come out, becos dem dey fear di Jews. 14. Wen di Festival don dey go on reach middle—nahin Jesus enta di worship-place, naso he…
-
John Chapter 8
Married Woman Wey Sleep Wit Anoda Man Jesus Words Na True 12. Wen Jesus follow di pipo tok again, he tok sey, “Na me be di light of dis world. Any-pesin wey follow me no go ever waka inside darkness. But he go get di light of life.” 13. Di Pharisees challenge am sey, “You see yoursef? You dey make-mouth about yoursef; your words no be true. 14. Jesus ansa dem, “Even if I tok about myself, my words na true. I know where I come from and I know where I dey go. But una no know where I come from, and where I dey go. 15. Una dey…