• Acts Chapter 14

    For Iconium For Lystra And Derbe 8. For Lystra, e get one man wey be cripple. He sidon and he no fit waka since dem born am. 9. He listen to Paul as he dey tok. Paul look am straight, con see sey di man get faith wey fit heal am. 10. Naso Paul halla, “Stand up wit your leg!” And di man jump up, con start to dey waka. 11. Wen di plenty-pipo wey gada see wetin Paul don do, dem halla wit Lycaonian language,“Di gods don come down to meet us as human beings!” 12. Dem call Barnabas- Zeus, and dem call Paul—Hermes, becos nahin be di chief…

  • Acts Chapter 15

    Di Meeting For Jerusalem Di Senior-men Letter To World- pipo (Gentiles) Wey Believe 22. Naso di apostles, plus senior-men, wit di full church, decide to choose some of dia own men, to send dem go Antioch—wit Paul and Barnabas. Dem choose Judas [wey dem dey call Barsabbas], plus Silas—two men wey be leaders among di brodas. 23. Dem send dis letter follow dem: Dis letter na from di apostles and senior-men, una brodas for Jerusalem. We dey write am to di Gentile believers for Antioch, Syria and Cilicia. Greetings! 24. We don hear sey some pipo wey we no send—komot from us, con dey give una wahala wit words, and…