• Acts Chapter 12

    Na Miracle Peter Take Escape From Prison As Herod Take Kpeme Herod komot from Judea go Caesarea, con stay for there small. 20. He bin dey quarrel wit di pipo of Tyre and Sidon—so dem join togeda to see how dem go take meet Herod. Afta dem secure di full support of Blastus—pesina assistant wey di king trust, dem ask for peace becos dem dey depend on di king kontri for food supply. 21. On dat day, Herod wear hin King cloth, he sidon for di king-chair con dey follow di pipo tok. 22. Di pipo con dey halla, “Dis na god voice, no be man.” 23. Sharply, naso angel…

  • Acts Chapter 13

    Dem Send Barnabas And Saul For Cyprus 4. Di two of dem wey di Holy Spirit send komot, con go Seleucia, naso dem follow boat from there go Cyprus. 5. Wen dem reach Salamis, dem tok about Baba-God word for di worship-place of di Jews. John sef dey there wit dem—dey epp dem. 6. Dem travel round di Island until dem reach Paphos. Na for there dem meet one Jew wey be jazzman. He be fake prophet wey dem dey call Bar-Jesus. 7. He dey work for di govnor, Sergius Paulus. Di govnor na man wey get-sense. He sey make dem go call Barnabas and Saul, becos he wan hear…