-
Romans Chapter 2
Baba-God Good Judgement Di Jews And Di Law 17. Now, una wey call unasef Jew dey depend on di law, and una dey make-mouth about Baba-God. 18. If you know wetin Baba-God want, and you know wetin dey right, becos dem don teach you about Baba-God law, 19. if you dey sure sey you fit lead blind pipo, and you be light for those pipo wey dey for inside darkness; 20. you fit teach mumu pipo, you fit teach small-small pikin about Baba-God way, and you know di law, and di truth inside di law, 21. so, you wey dey teach oda pipo, you no dey teach yoursef? You wey…
-
Romans Chapter 3
Baba-God Faithfulness No-pesin Dey Good 9. Wetin we go tok las-las? Sey we beta pass oda pipo? No! We don already tok sey Jews and world-pipo, all of dem dey under sin. 10. As dem don write am sey: “No-pesin dey good, no single pesin; 11. no-pesin understand, no-pesin dey fyne Baba-God. 12. All of dem don fashi, all of dem be gbanjo; no-pesin dey do beta tin, no single one.” 13. “Dia throat na open graves; dia tongues na 419.” “Snake poison dey for dia lips.” 14. “Dia mouth brekete wit curses, and dem get sharp-mouth.” 15. “Dia leg dey fast to go shed blood; 16. scata-scata and suffer-…