• Romans Chapter 8

      Life Tru Di Spirit Glory Wey Dey Come 18. I dey reason sey di suffer-head wey we dey face now, no reach di levels wey Baba-God go show us las-las. 19. Everitin wey Baba-God make—seriously dey wait for Baba-God pikin to show-face. 20. But di creation con experience some fraustration, no be on e own, but becos of Baba-God wey wish am to be like dat—but wit hope, 21. becos di creation esef go still free from death and to rotten—enta di glorious freedom of Baba-God pikin. 22. We know sey everitin wey Baba-God make don dey cry togeda—up till dis time, like cry of woman wey dey born…

  • Romans Chapter 9

    Baba-God Pesina Choice Israel No Gree Believe 30. Wetin we go tok? Baba-God don count world-pipo as good pipo—becos dem believe wit faith, even if dem no dey try to follow di law. 31. But Israel wey follow di law to be good pipo—neva  still be good pipo based-on di law. 32. Why? Becos dem dey try to be good pipo by keeping di law, instead of having faith in Baba-God. So dem kick di stone wey make dem stagger. 33. As dem write am sey, “See, I don put stone for Zion wey men go kick—con stagger, and rock wey go make dem fall. But shame no go ever catch pesin…