-
Colossians Chapter 1
Tanks-giving Plus Prayer 3. We dey always tank Baba-God, di Papa of awa Oga Jesus Christ, wen we dey pray for una, 4. since we hear about una faith inside Christ Jesus, and di love wey una get for all God-pipo, 5. becos of di hope wey dey for una for heaven. You get dis hope ever since you first hear about di truth of di good news. 6. Dis same good news wey come meet una, don dey spread around di world sef. E dey grow, just as e grow inside una—since di day wey una hear am, con sabi Baba-God grace for inside truth, 7. as una sef…
-
Colossians Chapter 2
Warning Against Errors Freedom From Control of Man Tru Life Wit Christ 6. So just as una receive Jesus Christ di Oga, kontinu to dey waka inside am. 7. Make una root dey inside Christ, grow inside am, and stand gidigbam inside di faith wey dem don teach una. And make una brekete wit tanks-giving. 8. Make sure sey no-pesin whyne [or hold-you-for-work] wit reasoning, plus useless mago- mago, based-on di tradition of men, and based-on spiritual pawas of dis world—instead of from Christ. 9. Na for inside Christ di full package of Baba-God [Olodumare] show esef for human being body. 10. You dey perfect inside Christ—wey be di head…