-
Colossians Chapter 3
Rules For Holy Life Rules For Christian House 18. Wives, obey your husbands, dis na beta character as follower of Christ. 19. Husbands, love your wives, and no treat dem wit bad- mind. 20. Pikin, obey your mama and papa for everitin, e dey make body sweet Baba-God. 21. Fadas, no make your pikin vex or dem no go get moral. 22. Workers, obey your oga for earth for everitin; and do am, no be becos dem dey look you, and so dat body go sweet dem, but serve dem wit your church-mind, and di fear of Baba-God. 23. Anytin wey you dey do, do am wit your whole heart,…
-
Colossians Chapter 4
1. Oga, give your workers wetin dey right and fair, becos you know sey you sef get Oga for heaven. More Teachings 2. Kontinu to dey pray seriously, dey watch inside your prayer—wit tanks-giving. 3. Make una pray for us sef, make Baba-God open door for awa message—so dat we go fit tok di deep-matas of Christ, wey make me dey for chains sef, 4. so dat I go fit tok, as I suppose tok am. 5. Use wisdom wen you dey run tins wit world-pipo; use everi chance well-well. 6. Make beta words always burku for your mouth, add salt join, so dat you go sabi ansa everi-pesin. Las-las…