-
1st Timothy Chapter 1
Warning Against Fake Teachers of Di Law 3. As I beg you wen I go Macedonia, stay for Ephesus, so dat you fit tell dem make dem no teach any oda teaching. 4. No let dem waste dia time dey reason some kain tori, or about who born who. All dis kain tins dey cos argument, instead of good teaching—inside faith. 5. Di koko of awa message, na love from pure heart, and beta mind, plus real faith. 6. But some pipo don miss-road, dem don turn komot from dis tins, con dey miss-yarn. 7. Dem wan be teachers of di law, but dem no know wetin dem dey tok…
-
1st Timothy Chapter 2
How Pipo Suppose To Dey Worship