-
2nd Thessalonians Chapter 2
Di Day Of Christ Stand Gidigbam 13. My pipo wey Baba-God love, we no fit stop to dey tank Baba-God sey he choose to save una—from di beginning, tru di work of di Spirit wey dey make pesin holy, and tru believing in di truth. 14. He call una to salvation, wen we tell una di good news, so dat una go fit share inside di levels of awa Oga Jesus Christ. 15. So, brodas, stand gidigbam, and hold di teachings wey una learn—whether na wit letter, or wit awa words. 16. Now make awa Oga Jesus Christ hinsef and Baba-God awa Fada, wey love us, con give us everlasting…
-
2nd Thessalonians Chapter 3
Prayer Request Warning Make Una No Dey Useless 6. Wit di name of awa Oga Jesus Christ, we dey tell una brodas, make una bone any broda wey dey live jagajaga life, and wey no dey follow di teachings wey una learn from us. 7. Unasef know how una suppose follow awa way, we no bin live jagajaga life among una, 8. we no chop any-pesin food wey we no pay for. Instead, we hustle for night and day, we hustle and we work, so dat we no go be like load for any-pesin head. 9. We do all dis tins no be becos we no get di right to…