• 1st Peter Chapter 5

      To Di Senior-men Plus Young Men Las-las Greetings 12. Wit di epp of Silas, wey I take as my faithful broda, I don write una dis short letter, to ginger una, and I dey preach to una, and dey tell una sey—na dis be di true grace of Baba-God—wey una dey stand put. 13. Your fellow church for here—for Babylon, dey send her greetings, and my son Mark—dey throway-salute sef. 14. Greet one anoda wit kiss of love. Alafia [peace] to all of una wey belong to Christ. Amen.

  • 2nd Peter Chapter 1

    Ogbonge And Beta Promises 3. Baba-God heavenly pawa don give us everitin wey we need to live beta life. We receive all dis tins as we con dey sabi Baba-God more-more—wey call us by hin levels plus goodness, 4. wey he take give us promises wey great well-well, and wey precious, so dat tru dem you go fit share inside hin heavenly character, as you don escape di corruption of dis world—tru awa body wey dey scratch us to do bad tin. 5. Nahin make you suppose try wella—to add faith join your beta-character, and add knowledge join your beta- character; 6. and to knowledge—add self-control; and to self-control—add endurance, and…