-
1st John Chapter 1
Di Word of Life To Dey Live Inside Di Light 5. Dis na di message wey we don hear from Jesus— con tell una: Baba-God na light, and darkness no dey for inside am at all. 6. If we claim sey we dey run tins wit Baba-God, and we still dey waka inside darkness, we dey lie and we no dey follow di truth. 7. But if we dey waka inside di light as Baba-God take dey inside di light, we dey rub- mind wit each oda, and di blood of Jesus—hin Son, go clean us from all sins. 8. If we claim sey we no get sin, we dey…
-
1st John Chapter 2
No Love Di World 15. No love di world or anytin wey dey inside di world. If any-pesin love di world, di love of di Fada no dey inside am. 16. Everitin wey dey for inside di world—di bad tins wey body dey scratch pipo to do, as dia eyes dey shuuk, and as dem dey make-mouth wit wetin dem get, and wetin dem don achieve; all dis tins no be from di Fada, but from di world. 17. Di world, plus all di sweet tins wey dey make pipo eyes dey shuuk—dey fade go, but di pesin wey dey do di tins wey Baba-God want—go live forever. Warning Against…