• Revelation Chapter 3

    To Di Church Wey Dey Sardis To Di Church Wey Dey For Philadelphia 7. “Write dis letter to di angel of di church wey dey for Philadelphia: Dis na di message of am—wey holy and true, wey hold di key of David. No-pesin fit close wetin he don open, and no-pesin fit open wetin he close. 8. I know una hustle. See, I don open door for una, wey no- pesin fit close. I know sey una get small pawa, but una don keep my word, and una neva fashi my name. 9. I go make those pipo wey belong to di church of Satan, wey claim sey dem be…