-
Revelation Chapter 1
Intro Greetings Plus Praise To Baba-God 4. Dis letter na from John, to di seven churches wey dey for Asia: Grace plus peace to una, from di Pesin wey dey, and wey don dey, and wey go come, and from di seven spirits wey dey for front of hin king-chair, 5. and from Jesus Christ, wey be di faithful witness to dis tins. Nahin be di firstborn from di dead, and nahin be di ruler of di kings of di earth. All glory to Jesus wey love us, and don wash us from awa sins wit hin blood. 6. He don make us to be kings, and priest to serve Baba-God…
-
Revelation Chapter 2
To Di Church Wey Dey For Ephesus To Di Church Wey Dey For Smyrna 8. “Write dis letter to di angel of di church wey dey for Smyrna: Dis na di message of di pesin wey be di First and Last, wey die, con come back to life again. 9. I know una hustle, suffer-suffer, and una poverty—but una still rich! I know di bad-mouth of those pipo wey dey claim sey dem be Jews, but dem no be Jews—but dem be church of Satan. 10. No fear anytin wey una go suffer. See, I dey tell una sey di devil go put some of una for prison—to test una,…