• Revelation Chapter 19

    Halleluya! Di Pesin Wey Dey Ride Di White Horse 11. I see heaven open down for my front, and one white horse con show, dem dey call di Pesin wey dey ride am—Faithful and True. Wit justice na he take dey judge and fight war. 12. Hin eyes dey shine like faya, and many crowns dey for hin head. He get name wey dem write for hin body—wey no-pesin but only am know. 13. He wear cloth wey dem soak inside blood, and hin name na di word of God. 14. Di armies of heaven dey follow am, dem dey ride white horse, and dem wear fine linen—white and clean.…

  • Revelation Chapter 20

    Di Thousand Years Satan Yawa 7. Wen di one thousand years don finish, dem go release Satan from prison, 8. and he go go out to play di nations wayo—wey dem dey call Gog and Magog, for di four corners of di earth. He go gada dem togeda for fight, and dia numbas plenty like sand-sand for beach. 9. Dem march cross from one side of di earth to di oda side, con surround di camp of Baba-God pipo, di city wey he love. But faya come down from heaven con burn dem. 10. And dem throw di devil wey play dem wayo inside river of faya, where dem throw…