-
Revelation Chapter 21
Di New Jerusalem
-
Revelation Chapter 22
Di River Of Life Jesus Dey Come 7. “ I go soon come! Blessings for di pesin wey keep di words of di prophecy for inside dis book.” 8. Me, John—na me be di pesin wey hear—con see all dis tins. And wen I hear and see dem, I kneel down, con worship di angel wey dey show dem to me. 9. But he tell me sey, “No do am, I be Baba-God servant like you, just like your brodas—di prophets, and everi-pesin wey keep di words of dis book. Worship Baba-God!” 10. He con tell me sey, “No keep di yarnings of di prophecy of dis book as secret,…