Proverbs Chapter 16
Na Baba-God Dey Give Pesin Wetin To Tok
- Man get plan for hin heart, but na Baba-
God dey give am di correct ansa to tok. - All man way dey pure for hin eyes, but na
Baba-God dey judge hin spirit. - Commit your business to Baba-God, and
your plan go stand gidigbam. - Baba-God don make everitin for
hinsef—even badbelle pipo dey wait to fall
wen kasala go burst. - Any-pesin wey dey feel- big na tufiakwa to
Baba-God, even if dem join dia head togeda,
none of dem go escape wit-out punishment. - Na wit mercy plus faithfulness, pesin
fit pay for sin; and na di fear of Baba-God dey
make man komot from bad tin. - Wen Baba-God love man way, he go make
even hin enemies make peace wit am. - E beta make you get small tin wit clean-
hand, dan to get plenty moni wit ojoro. - Man get plan for hin heart, but na Baba-
God dey tell am where he go waka go. - Oba lips na oracle, and hin lips no
suppose judge wit ojoro. - Baba-God like correct measurement and
balance, all di weight for di bag na hin work. - Na tufiakwa for oba to do wicked tins, na
goodness dey make king-chair stand
gidigbam. - Kings like pesin wey dey tok true; dem
love pipo wey dey tok di right tins. - Wen king vex, e be like messenger of
death, but wise man go cool am down. - Wen king face dey smile, e mean life; and
hin favour be like las-las rain for raining
season. - E beta make you get wisdom—dan make
you get gold, e beta make you choose
understanding—dan make you choose
silver - Di highway of pesin wey get clean-hand
na to komot from evil, any-pesin wey dey
watch hin way, go dey safe. - Afta pesin carry shoulder up, las-las he
go fall, and spirit wey dey feel-big—go soon
fall. - E beta make pesin live simple life wit
low-key pipo, dan to share evil moni wit pipo
wey dey make-mouth. - Any-pesin wey dey hear word—wit
sense, go see alubarika (blessings), and di
pesin wey trust Baba-God go always dey
happy. - Dem know wise pipo for dia
understanding, and beta words dey promote
learning. - Understanding na water of life wey dey
flow to those pipo wey get am, but di
correction of mumu pipo na yeye. - Wise man heart dey guide hin mouth, and
e dey teach am how to sabi tok. - Beta words na honey wey dey sweet for
di soul, and wey dey give good health to di
bone. - Man get hin way, wey be like sey e dey
right for hin eyes, but dat way dey lead to
death las-las. - Pesin wey dey hustle, dey hustle for
hinsef, na hin mouth wey dey hungry dey
ginger am. - Evil man dey plan evil tins, and e dey for
hin lips like faya wey dey burn. - Corrupt man dey cos kwanta, and tatafo dey separate correct padi.
- Man wey like to shed blood dey tempt
hin neighbour, con carry am enta bad way. - He dey close hin eyes to plan bad tin, and
he dey run hin lips—to make evil come to
pass. - White hair na crown of levels, you fit
only get am from beta life. - Pesin wey no dey quick vex beta pass
man wey get pawa; man wey dey control hin
spirit—beta pass man wey fit control full
city. - Dem don throw coin up, but na Baba-
God go decide which side go face up or
down.