Proverbs Chapter 17

Abeg share

E Beta Make You Chop Dry Food
Wit Peace

  1. E beta make pesin use peace chop small
    food wey don dry, dan make pesin dey for
    house wey dem dey chop belleful—but wit
    kwanta.
  2. Wise servant go rule son wey dey bring
    disgrace, con share inside di properties
    among di brodas.
  3. Na faya dem take dey test as silver or gold
    pure reach, but na Baba-God dey test pesin
    heart.
  4. Badbelle pipo dey listen to wicked pipo,
    and lie-lie pipo like to listen to aproko
    tongue.
  5. Pipo wey dey yab poor pipo no dey respect
    Baba-God wey make dem; Baba-God must
    punish pesin wey dey happy sey kasala don
    burst.
  6. Pikin-pikin na crown for pesin wey don
    old, and pikin suppose dey proud of hin
    papa.
  7. Beta tok no-fit mumu mouth—tokless of
    prince wey dey tok lie.
  8. Gift na jazz for di eyes of any-pesin wey
    dey give am; he go succeed anywhere he go.
  9. Any-pesin wey cover pesin mistake dey
    promote love, but any-pesin wey dey do
    tatafo—go separate padi.
  10. If you correct pesin wey get-sense, he go
    happy well-well pass make dem blow mumu
    hundred times.
  11. Evil man only just wan rebel, so dem go
    send wicked messenger against am.
  12. E beta make you jam bear wey dem tiff e
    pikin, dan make you meet mugu as e dey show hinsef.
  13. If pesin use evil take pay back good, evil
    no go ever komot from hin house.
  14. To start quarrel be like make pesin cos
    flood, so drop di kwanta before fight start.
  15. Pesin wey dey support evil, and wey
    condemn innocent pipo—both of dem na
    tufiakwa to Baba-God.
  16. Why moni dey for mumu pesin hand to
    buy wisdom, wen he no ready to learn?
    (Moni-miss-road)
  17. Padi dey show love everi time, but dem
    born your broda to stand for you wen yawa
    gas.
  18. Pesin wey no-get-sense dey do guarantor
    for hin neighbour debt.
  19. Pesin wey like sin—love kwanta; pesin
    wey trust hin high fence—dey invite scata-
    scata.
  20. Man wey get bend-bend heart no-fit
    prosper; pesin wey get wayo mouth go enta
    one-chance.
  21. To get mumu pikin dey bring pain; no joy
    for di papa of mumu pesin.
  22. Heart wey dey jolly—dey do good like
    medicine, but spirit wey don taya—dey
    make bone dry.
  23. Wicked man dey collect egunje (bribe)
    for back—con do ojoro.
  24. Man wey get-sense dey always dey look
    wisdom, but mumu pipo eyes dey shuuk
    reach di end of di earth.
  25. Mumu pikin dey make dia papa sad, and
    dey make dia mama feel pain.
  26. E no good make pesin punish innocent
    pesin, or to punish leader becos he do beta
    tin.
  27. Man wey know sometin dey hold hin
    mouth wen he wan tok, and man of
    understanding get jeje spirit.
  28. Pipo go count mugu as pesin wey get-
    sense wen he dey quiet, and pipo go tink sey
    he dey reason beta tin if he close hin lips.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *