- Why di nations and di pipo dey waste dia time dey plan bad codedly?
- Di kings of dis earth don decide and di rulers don gather together to change am
for di Lord and hin anointed one.
- Dem sey, “Make we cut dia chain con throway dia chains.”
- Baba-God wey sidon for hin throne for heaven con laff. He yab dem.
- God con yari for dem as he change am for dem. He con tok sey,
- “I don raise my own King for Zion untop my holy hill.”
- I go yarn di word of God. Baba-God yarn me sey, “You be my pikin, today I go
be your Papa.
- Ask me, and I go make di nations your kingdom and I go even give you di end of
di world as your property.
- You go rule dem wit iron staff. You go break dem to pieces like pot wey you dey
mold.
- So Kings, make una get sense; I dey warn una wey be rulers of dis earth.
- Sever Baba-God wit fear and cut-cap for am as you dey fear am. And make di
wonders of God make you jirate.
- Kiss di son unless he go use vex con pkafuka your way. No use Baba-God play,
he fit vex for you now-now-now. Blessed na di pipo wey dey hide dia head for hin
body.
Post Views: 80