Psalm Chapter 1
- Blessed na di man wey no dey reason di advice of badbelle pipo, or wey dey
stand for di way of sinners, or wey sidon wit pipo wey dey yarn opkata. - But wetin dey make body sweet am na di law of Baba-God, and he dey meditate
wit Baba-God law everi-day and night.
- He be like tree wey dey grow near river, wey dey produce fruit for hin season
and wey hin green leave no dey pkeme. Anytin wey dat pesin do dey blow yakata. - But no be so for badbelle pipo dem. Dem be like chaff wey breeze dey blow
comot. - So evil pipo no go fit stand dey judge God-pipo, or badbelle dey for where God-
pipo gather put. - Baba-God dey watch hin pikin dem, but badbelle pipo way go pkeme.
Questions about Psalm 1
What is Psalm 1 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 1 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-1/
Where can I read Psalm 1 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 1 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-1/
Which Bible book contains Psalm 1?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 1?
The chapter identified by this reference is 1.
Topics connected to this passage
- Guidance