Psalm Chapter 3
- Chai Baba-God, how many my enemies be sef? How many of dem wan change
am for me! Many of dem dey yarn me sey, “Baba-God no go fit save am.” - But na you dey gaurd round me. Chai Baba-God, you just dey make my head
shine, con carry my head go up. - Na Baba-God I dey raise my voice for, he dey ansa me from hin holy hill.
- I lie down sleep; con wakeup again, becos na you dey keep me alive.
- I no go fear di more dan ten thousand pipo wey wan fight me for every corners.
- Oh Bab-God arise! Save me, Oh Oghene. Nack all my enemies for jaw; brake
wicked pipo teeth. - Na from Baba-God freedom dey from come. Make your blessings dey upon us
forever.
Questions about Psalm 3
What is Psalm 3 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 3 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-3/
Where can I read Psalm 3 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 3 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-3/
Which Bible book contains Psalm 3?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 3?
The chapter identified by this reference is 3.
Topics connected to this passage
- Salvation
- Fear