Psalm Chapter 2
- Why di nations and di pipo dey waste dia time dey plan bad codedly?
- Di kings of dis earth don decide and di rulers don gather together to change am
for di Lord and hin anointed one. - Dem sey, “Make we cut dia chain con throway dia chains.”
- Baba-God wey sidon for hin throne for heaven con laff. He yab dem.
- God con yari for dem as he change am for dem. He con tok sey,
- “I don raise my own King for Zion untop my holy hill.”
- I go yarn di word of God. Baba-God yarn me sey, “You be my pikin, today I go
be your Papa. - Ask me, and I go make di nations your kingdom and I go even give you di end of
di world as your property. - You go rule dem wit iron staff. You go break dem to pieces like pot wey you dey
mold. - So Kings, make una get sense; I dey warn una wey be rulers of dis earth.
- Sever Baba-God wit fear and cut-cap for am as you dey fear am. And make di
wonders of God make you jirate. - Kiss di son unless he go use vex con pkafuka your way. No use Baba-God play,
he fit vex for you now-now-now. Blessed na di pipo wey dey hide dia head for hin
body.
Questions about Psalm 2
What is Psalm 2 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 2 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-2/
Where can I read Psalm 2 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 2 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-2/
Which Bible book contains Psalm 2?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 2?
The chapter identified by this reference is 2.
Topics connected to this passage
- Prayer
- Fear
- Guidance