- Make di mighty pipo tok sey Baba-God get glory and strength.
- Give Baba-God di glory wey fit hin name; worship Baba-God inside di beauty of
hin Holliness.
- Baba-God voice dey ontop of waters; di God of glory dey halla like thunder,
Baba-God dey halla like thunder ontp di ocean.
- Baba-God voice get power well-well, God voice dey royal.
- Baba-God voice fit break strong wood; Baba-God go break into pieces, di cedar
of Lebanon.
- He go make Lebanon skip like nama pikin, and Sirion like young ox wey wild.
- Baba-God voice dey strike wit flash of lightening.
- Baba-God voice dey shake di desert; God dey shake di desert of Kadesh.
- Baba-God voice dey twist oaks, and hin voice fit fall all di tree for inside bush.
And for inside hin temple everi-pesin go sing, “Glory!”
- Baba-God sidon for throne ontop of water; God dey for the throne as king
forever.
- Baba-God dey give hin pipo strength; God dey bless hin pipo wit peace.
Post Views: 44