Psalm Chapter 3

Abeg share
  1. Chai Baba-God, how many my enemies be sef? How many of dem wan change
    am for me! Many of dem dey yarn me sey, “Baba-God no go fit save am.”
  2. But na you dey gaurd round me. Chai Baba-God, you just dey make my head
    shine, con carry my head go up.
  3. Na Baba-God I dey raise my voice for, he dey ansa me from hin holy hill.
  4. I lie down sleep; con wakeup again, becos na you dey keep me alive.
  5. I no go fear di more dan ten thousand pipo wey wan fight me for every corners.
  6. Oh Bab-God arise! Save me, Oh Oghene. Nack all my enemies for jaw; brake
    wicked pipo teeth.
  7. Na from Baba-God freedom dey from come. Make your blessings dey upon us
    forever.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *