Psalm Chapter 4
- Ansa me wen I dey call you, Oh my righteous God.
Cool me down from my wahala; sorry for me, make you hear my prayer. - Oh men, how long una go dey turn Bab-God glory to mumu-tin? How long una
go dey deceive unasef con dey fyne foriegn gods. - I want make una know sey Baba-God don choose holy-pipo for hinsef; Baba-
God go hear me wen I call am. - No do bad becos you dey vex; wen you dey for bed, look inside your heart,
make you dey quite. - Offer di right sacrifices and trust Baba-God.
- Many pipo dey ask, “Who go fit show us any beta tin? Make di light wey dey
your face shine upon us, O Lord. - You don make my heart full wit jolly-jolly even pass wen dia food and drink
brekete. - I go lie down sleep wit peace, becos na only you dey save my life.
Questions about Psalm 4
What is Psalm 4 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 4 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-4/
Where can I read Psalm 4 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 4 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-4/
Which Bible book contains Psalm 4?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 4?
The chapter identified by this reference is 4.
Topics connected to this passage
- Faith
- Prayer
- Salvation
- Peace