- Ansa me wen I dey call you, Oh my righteous God.
Cool me down from my wahala; sorry for me, make you hear my prayer.
- Oh men, how long una go dey turn Bab-God glory to mumu-tin? How long una
go dey deceive unasef con dey fyne foriegn gods.
- I want make una know sey Baba-God don choose holy-pipo for hinsef; Baba-
God go hear me wen I call am.
- No do bad becos you dey vex; wen you dey for bed, look inside your heart,
make you dey quite.
- Offer di right sacrifices and trust Baba-God.
- Many pipo dey ask, “Who go fit show us any beta tin? Make di light wey dey
your face shine upon us, O Lord.
- You don make my heart full wit jolly-jolly even pass wen dia food and drink
brekete.
- I go lie down sleep wit peace, becos na only you dey save my life.
Post Views: 67