Psalm Chapter 41

Abeg share
  1. Blessed na di man wey dey reason pipo wey no get power; na Baba-God dey
    save am wen kasala burst.
  2. Baba-God go protect am and keep hin life; God go bless am for di land and
    Baba-God no go let the bad tins wey badbelle pipo want make e happun to am,
    happun to am.
  3. Baba-God go keep am wen hin sick ontop bed, con make am stand up from hin
    sickbed.
  4. I sey, “Oh Baba-God, sorry for me; heal me, I don sin against you.”
  5. Wit badbelle, my enemies tell me sey, “Wen he go pkie and he name go
    pkeme?”
  6. He dey lie for my head any time pesin fyne me come, he dey lie for my head, as
    hin heart dey gather bad tins wey he wan yarn about me; naso he go go out con
    start to dey do tatafo.
  7. All my enemies dey tok my mata small-small; dem dey imagine sey sometin bad
    go happen to me. Dem sey,
    8.“Evil disease don catch am; he no go fit ever stand up from di place wey hin dey
    sleep.”
  8. Even my padi wey I trust, wey I dey follow me chop don change am for me.
  9. But you, Oh Baba-God, sorry for me; carry me up so dat I do make pay for
    wetin dem do.
  10. I know sey you dey happy wit me, my enemies no go fit win me.
  11. You dey keep me inside my honesty.
  12. Prasie be to Baba-God, di God of Israel, from everlasting to everlasting. Amen
    and Amen.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *