Psalm Chapter 40
- I wait patiently for Baba-God, he look me con hear my cry.
- He carry me comot from inisde hole wey dror dey, comot from portor-portor
and mud, he con put my leg ontop rock, con give me strong place wey I go stand. - He put new song for my mouth, I go use hymn praise hin name. Many pipo go
see con fear, con put dia faith for Baba-God. - Blessed na di man wey make Baba-God hin trust, wey no dey look pipo wey dey
make-mouth, wey no dey look pipo wey turn dey serve foreign gods. - Di wonders wey you don do brekete. No-pesin fit count di tins wey you plan for
us; if I wan yarn and tok about dem, dem too plenty for me to tok. - Sacrifice and offering wey you no really want, but you don shuuk my ears;
burnt offering plus sin offering wey you no really want. - I con tok sey, “Na me be dis, I don come—dem write about me for inside di
book. - I really wan do your will Oh Baba-God; your law dey inside my heart.”
- I go tok about righteousness for where God-pipo gather; Baba-God you know
sey I no go close my lips. - I no dey hide your righteousness for my heart; I dey yarn about your
faithfulness and salvation. I no hide your love and truth from your pipo wey
gather. - No hide your mercy from me Oh Baba-God; make your love and your truth
always protect me. - Plenty-pleny palava wey I no fit count don round me; my sins don cover me,
and I no fit see. My sins plenty pass the hair wey dey my head. And e be like sey
my heart wan fail. - Make your body sweet you to save me. kiakia come epp me.
- Make shame and kata-kata catch all those pipo wey want make I pkeme.
Disgrace all those pipo wey want be I fall down. - Make all those pipo wey dey tell me sey, “Aha! Aha!” dey surprise for di
shame wey go catch dem. - But make all those pipo wey fyne you happy well-well. May all those pipo wey
like the wey you take save us always tok sey, “Make Baba-God get level!” - But I poor and I no get shi-shi, make Baba-God tink about me. Na you be my
epp and na you dey save me; O Baba-God, no delay.
Questions about Psalm 40
What is Psalm 40 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 40 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-40/
Where can I read Psalm 40 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 40 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-40/
Which Bible book contains Psalm 40?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 40?
The chapter identified by this reference is 40.
Topics connected to this passage
- Love
- Faith
- Hope
- Salvation
- Forgiveness
- Fear
- Strength
- Money
- Worship