- Clap una hand all di nations; shout to Baba-God wit cry of Joy.
- Baba-God wey be di Oga pkatapkata na ogbonge, nahin be di great king for di
earth.
- He make nations obey us and he put pipo under our leg.
- Nahin dey choose awa inheritance for us, di pride of Jacob wey he love.
- Baba-God don ascend from inside di shout of Joy, and di Lord don ascend from
di trumpet wey dey halla.
- Make una sing praises to Baba-God, make una sing, make una sing praises to
awa king, make una sing.
- Na Baba-God be di king of all di earth, use psalm of praise sing for am.
- Baba-God dey reign over all di nations. Baba-God sidon for hin holy throne.
- Di bigmen of di nation gather together as di pipo of di God of Abraham. Na
Baba-God nahin get di kings of di earth. Hin level high well-well.
Post Views: 36