Psalm Chapter 47
- Clap una hand all di nations; shout to Baba-God wit cry of Joy.
- Baba-God wey be di Oga pkatapkata na ogbonge, nahin be di great king for di
earth. - He make nations obey us and he put pipo under our leg.
- Nahin dey choose awa inheritance for us, di pride of Jacob wey he love.
- Baba-God don ascend from inside di shout of Joy, and di Lord don ascend from
di trumpet wey dey halla. - Make una sing praises to Baba-God, make una sing, make una sing praises to
awa king, make una sing. - Na Baba-God be di king of all di earth, use psalm of praise sing for am.
- Baba-God dey reign over all di nations. Baba-God sidon for hin holy throne.
- Di bigmen of di nation gather together as di pipo of di God of Abraham. Na
Baba-God nahin get di kings of di earth. Hin level high well-well.
Questions about Psalm 47
What is Psalm 47 in Pidgin Bible?
This page contains Psalm 47 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/psalm-chapter-47/
Where can I read Psalm 47 in Nigerian Pidgin?
You can read Psalm 47 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/psalm-chapter-47/
Which Bible book contains Psalm 47?
Psalm is the Bible book identified by this reference.
What chapter is Psalm 47?
The chapter identified by this reference is 47.
Topics connected to this passage
- Love
- Worship
- Obedience