- Baba-God great and he get levels to recieve awa praise, for inside di city of awa
God, for hin holy mountain.
- E fine well-well no be for mouth, body dey sweet di whole earth. Like di up-up-
up of Zaphon naso mount Zion be, di city of di ogbonge king.
- Baba-God dey inside her strong-house; he don show hinsef to be her strong-
house.
- Wen di king put-hand-together, wen dem carry-go together,
- dem see her con surprise, dem gbess wit gbege for dia head.
- Dem dey shake for where dem dey, dem dey feel pain like woman wey wan
born pikin.
- You scata dem like ship to Tarshish wey di east breeze blow scata throway.
- As we don hear, naso we don see for di city God almighty city, for inside di city
of awa God: Baba-God don make her dey secure forever.
- For inside you temple, Oh Baba-God, we go dey meditate on your love wey no
dey fail.
- Like your name, naso your praises dey reach di end of di earth; your right
hand full wit righteousness.
- Mount Zion dey jolly, di villages wey for inside Judea dey happy becos of your
judgement.
- Waka upandan for inside Zion, count her tall buildings,
- reason her wall, look her strong-houses, so dat una go fit tell di next
generation about dem.
- Dis God na awa God for ever and ever; he go be our guide reach di end.
Post Views: 20