- Dey hear my word Oh Oga. Reason my small-small cry.
- Listen to my cry for epp, my Oba and my God, na you I dey pray to.
- For morning, Oh baba, you dey hear my voice; for morning, I dey ask you wetin
dey for me? and I dey wait like woman wey get belle.
- You no be God wey like evil tin; badbelle pipo no fit stay for where you dey.
- Pipo wey dey carry-shoulder no fit no fit stand for your front.
- You dabaru those pipo wey dey tok lie. Baba-God hate men wey like blood and
wayo-pipu.
- But me, wit your ogbonge mercy, I go enta inside your house; I go use respect
bow down face your holy temple.
- Oh Baba-God, show me road inisde your righteousness becos of my
enemies—make your way straight for me.
- Pesin no fit trust anytin wey dem yarn; dia heart full wit scat-scata. Dia throat
be like grave wey open down; dem dey yarn wayo wit dia tongue.
- Declear sey dem dey guilty, Oh God! Make dia coded bad plan fall dia hand.
Pursue dem comot becops of dia sins wey plenty, becos dem don rebel against
you.
- But make all those pipo wey dey hide dia head for your body dey happy; make
dem always dey sing beta song from dia belle. Spread your protection to cover
dem, so dat those pipo wey love your name go happy for you.
- You dey bless righteous pipo for sure you dey surround dem wit you favour
like guard.
Post Views: 65