- O Baba-God, na you be my God, I dey fyne you seriously; my soul wan drink you
like water, my body really want you, for land wey dry and for land wey no good,
where water no dey.
- I don see you for inside your holy-place, I don see your power and your glory.
- Becos your love beta pass life, my lips go give you levels.
- I go praise you as long as I dey alive, and I go lift up my hand for your name.
- My soul go bellefull like pesin wey dey chop beta food, my lips go dey sing dey
praise you.
- I go remember you ontop bed; I dey tink of you throughout di night.
- Becos na you dey epp me. Na under your wings I for dey sing.
- My soul dey hold you thight; your right hand hold me strong.
- God go scata those pipo wey dey fyne my life; dem go fall six feeth.
- Death go shuuk dem wit hin sword and dem go turn to food for jakals.
- But di king go happy for Baba-God; all those pipo wey dey swear wit Baba-God
name go praise am, as lie-lie pipo mouth go keep quite.
Post Views: 71