Romans Chapter 13

Abeg share

Sempe For Di Leaders

  1. Everi-pesin must obey di leaders. No pawa dey except na pawa of Baba-God. And Baba-God nahin put leaders for dia position.
  2. Any-pesin wey no obey leaders, dey disobey wetin Baba-God don stand, and those pipo wey do like dat—go receive punishment.
  3. Govment, no dey attack pipo wey dey do di right tin, but na those wey dey do evil. If you wan free from govment wahala? Do di right tin, and dem go honour you.
  4. Govment be like Baba-God servant wey suppose do beta tin for di pipo. Make fear catch you if you do evil, becos leaders get di pawa to punish you. Leaders na servant wey Baba-God send to punish pipo wey dey do evil.
  5. So e good make we sempe for di leaders, no be sey becos dem go fit punish us, but becos of awa conscience.
  6. Nahin make you dey pay tax. Dem dey serve Baba-God as dem dey do dia work everi time.
  7. Give everi-pesin wetin you dey owe dem: if you dey owe tax—pay di tax; if na moni—pay di moni; if na respect—give respect; if na honour—give honour.

Love Na Di Koko Of Di Law

8. No owe any-pesin anytin—except to love one anoda, any-pesin wey love hin neighbour don do wetin di law want.

9. Di commandments nahin be dis, “No climb pesin husband or wife, no kill pesin, no steal, no lie for your neighbour head, no use ogboju,” and if any oda commandment dey, na di koko of all of dem be dis: “Love your neighbour as you take love yoursef.”

10. Love no dey do wrong tin to hin neighbour—so love na di koko of di law.

11. And do like dis; understand wetin dey happun. Time don reach wey una go soji [wake up] from una sleep, becos awa salvation don near pass as e be before—wen we first believe.

12. Di night don almost finish, di day don dey reach. So make we komot hand from di works of darkness, con wear di fighting-cloth of light.

13. Make we waka wit clean-heart—as if na day time, no be to dey flex and jogodo, or sex anyhow, or make body dey scratch you to do bad tin, or kwanta and jealousy.

14. Instead, wear Oga Jesus Christ for your body, and no reason how to do di bad tins wey your body dey scratch you to do.

Questions about Romans 13

What is Romans 13 in Pidgin Bible?

This page contains Romans 13 in Nigerian Pidgin Bible. Read the passage here: https://pidginbible.com/romans-chapter-13/

Where can I read Romans 13 in Nigerian Pidgin?

You can read Romans 13 in Nigerian Pidgin on Pidgin Bible: https://pidginbible.com/romans-chapter-13/

Which Bible book contains Romans 13?

Romans is the Bible book identified by this reference.

What chapter is Romans 13?

The chapter identified by this reference is 13.

Topics connected to this passage

  • Love
  • Faith
  • Salvation
  • Fear
  • Family
  • Obedience

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Share Pidgin Bible App
×

Support di Pidgin Bible ❤️

Help us print 10,000 copies of di Bible to spread Baba-God word more, for language wey di pipo fit understand. No amount dey too small or big. God bless you as you give.

⭐ Rate Pidgin Bible

We hope say di Pidgin Bible don bless your life.

Abeg give us a 5-Star Review for Google Play Store. Your review go help more people discover Baba-God Word.

⭐ Review Now