Leviticus

Leviticus Chapter 18

Abeg click here to share dis post

Sex Wey Dey Against Di Law

1. So Baba-God tell Moses sey,

2. “Follow di pipo of Israel tok, and make you tell dem sey: ‘Na me be Baba-God wey be una Oga.

3. Una must no do as di pipo of Egypt dey do—where una bin dey live before, and una must no do as dem dey do for di land of Canaan, where I carry una come from. No follow dia ways.

4. You must obey my laws and you must keep my words, con follow dem. Na me be Baba-God wey be una Oga.

5. So make una keep my words and my laws, becos di man wey do dem go live by dem. Na me be Baba-God.

6. “Make no pesin go meet hin close family-pesin for sex. Na me be Baba-God.

7. “No disrespect your papa by sleeping wit hin wife—your mama; she be your mama, no komot her cloth.

8. “No sleep wit your papa wife; dat one go disrespect your papa.

9. “No get sex relationship wit your sista, either your papa daughter or your mama daughter, wey dem born una for di same house or for anoda place.

10. “No sleep wit your son daughter, or your daughter—daughter; dat one go bring disrespect for you.

11. “No sleep wit di daughter of your papa wife, wey dem born for your papa; she be your sista, you must no see her nakedness.

12. “No sleep wit your papa sista, she be your papa close relation.

13. “No sleep wit your mama sista becos na your mama close relative.

14. “No disrespect your papa broda by going to meet hin wife for sex. She be your aunty.

15. “No sleep wit your daughter-in-law. She be your son wife; no see her nakedness.

16. “No sleep wit your broda wife; dat one go disrespect your broda.

17. “No sleep wit woman and her daughter. No sleep wit her son daughter, or her daughter—daughter, dem be close relative. Dat one na wickedness.

18. “No take your wife sista as anoda wife, to make her vex, or sleep wit her even as your wife dey alive.

19. “No go meet woman for sex wen she dey for her monthly period.

20. “No sleep wit you neighbour wife, con corrupt yoursef wit her.

21. “No give any of your pikin to be sacrifice for Molech, becos you must no bring shame to di name of your God. Na me be Oga.

22. “No sleep wit man as if na woman; na tufiakwa.

23. “No sleep wit animal, con corrupt yoursef wit dat kain tin. Woman must no carry hersef give animal to sleep wit am; na bend-bend way be dat.

24. “No corrupt yoursef in any of dis way, becos naso di nations wey I go pursue komot take corrupt demsef;

25. Even di land con corrupt; so I punish am for di sin, and di land con vomit di pipo wey dey live for there.

26. But you must keep my words and my laws. Both di pipo of Israel or foreigners must no do all dis tufiakwa.

27. “Na all dis tufiakwa di pipo dey do for di land wey I wan carry una go, and naso dem take corrupt di land.

28. And if you corrupt di land, di land go vomit you out, just as e take vomit di nations wey dey for una front.

29. “Any pesin wey do any of dis tufiakwa, must cut komot from hin pipo.

30. Keep my laws and make una no follow any of di tufiakwa traditions wey dem dey do before una come. And make una no corrupt unasef wit dem. Na me be Baba-God wey be una Oga.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website