Leviticus Chapter 19
Different-different Laws
- Baba-God con tell Moses sey,
- “Tok to all di pipo of Israel wey gada togeda, con tell dem sey: “Make una holy, becos me, Baba-God wey be una Oga dey holy.
- “Everi one of una must respect hin mama and papa, and una must keep di Sabbaths. Na me be Baba-God wey be una Oga.
- “Make una no turn to idols, or make gods wey dem build wit iron for unsef. Na me be Baba-God una Oga.
- “Wen una sacrifice peace offerings to Baba-God, sacrifice am wit free-mind.
- Chop am di day wey you sacrifice am, or di next day, una must burn anytin wey remain on di third day.
- If una chop any one of dem on di third day, e no dey pure and Baba-God no go accept am.
- Any pesin wey chop am on di third day go receive punishment for corrupting wetin dey holy to Baba-God, and make dem cut di pesin komot from di pipo.
- “Wen you harvest from your land, no harvest di plants wey dey for di corner of your farm, and no pick di fruits wey remain for di farm.
- No pick di fruits wey remain for your grape-farm—no pluck everi last bunch of grapes from di tree, and no pick di grapes wey fall for ground. Leave dem for poor pipo and for di foreigners wey dey live among una. Na me be Baba-God una Oga.
- “No steal
“No tok lie.
“Make una no do mago-mago.
12. “Make una no use Baba-God name take swear wit wetin no dey true, con carry shame put for Baba-God name.
13. “No scam your neighbour or rob am.
“No hold di salary of your worker overnight reach morning.
14. “No curse pesin wey deaf, or put sometin for blind pesin road wey go make am fall, but fear your God. Na me be Baba-God your Oga.
15. “No bend justice; no show partiality to poor pipo, or favour big-men, but judge your neighbour wit your church-mind.
16. “No dey waka upandan dey bad-mouth your pipo.
“No do anytin wey go dey against your neighbour life. Na me be Baba-God.
17.“No get badbelle for your broda. Correct your neighbour wit your church-mind so dat you no go share inside hin sin.
18. “No try to revenge or get badbelle for your pipo, but love your neighbour as you take love yoursef. Na me be Baba-God.
19. “Keep my words.
“No make different kind of animals sleep wit each oda.
“No plant two different kind of seed for your farm.
“No wear cloth wey dem weave wit two kind of material.
20. “If girl wey be slave and wey don promise to be di side-chick of man, den anoda man con sleep wit her, dem go receive punishment, but dem no go kill dem, since she be slave.
21. Di man must bring ram come front of di worship-place for guilty offering to Baba-God.
22. Di priest go use di ram of di guilty offering take clean hin sin, and Baba-God go forgive di sin.
23. “Wen you enta di land, con plant different-different kind of fruit trees for food, take di fruit as sometin wey you forbid. For three years you go take am as fruit wey you forbid, you must no chop am.
24. On di fourth year, all di fruit go dey holy, as offering of praise to Baba-God.
25. But on di fifth year, you fit chop e fruit. Naso una harvest go take burku more-more. Na me be Baba-God wey be una Oga.
26. “No chop any meat wey di blood still dey inside di body.
“No do jazz, or connect wit spirit to predict wetin go happun.
27. “No cut di hair wey dey for di sides of your head, or cut your bear-bear.
28. “No cut your body becos of dead pesin, or put tattoo or any marks for your body. Na me be Baba-God wey be una Oga.
29. “No downgrade your daughters by turning her to ashawo, or di kontri to plenty wit ashawo, and wickedness go brekete for di land.
30. “Keep my Sabbaths and respect my holy place. Na me be Baba-God.
31. Una must no corrupt unasef by meeting jazzmen or meeting pipo wey dey tok to dead pipo. Na me be Baba-God una Oga.
32. “Stand up wen you see senior-pipo, show respect for old pipo, and fear Baba-God your Oga. Na me be Baba-God.
33. “Wen foreigner dey stay for una land, make una no do am anyhow.
34. Una must treat di foreigner wey dey stay wit una like sey na from una land. Love am as you take love yoursef becos una bin live for Egypt as foreigners. Na me be Baba-God wey be una Oga.
35. “No use measurement wey no correct wen you dey measure anytin for pesin.
36. Use correct weight plus correct measurement. Una containers for measuring tins must dey correct; Na me be Baba-God una Oga wey carry una komot from Egypt.
37. Keep all my words, plus all my laws and follow dem. Na me be Baba-God.’ ”