Leviticus Chapter 3
Di Peace Offering
- “If pesin wan give sacrifice of peace offering from hin malu, make he bring male or female malu wey no get comma for body—come meet Baba-God.
- And make he lay hin hand on di head of di offering, con kill am for di door of di worship-place, den Aaron sons wey be di priests go sprinkle di blood round di altar.
- From di peace offering, make he bring sacrifice wey dem make to Baba-God wit faya: all di fat wey cover di inside parts, plus all di fat wey dey inside di animal,
- di two kidneys wit di fat wey dey on dem—near di waist, and di fat part wey dey for di liver, wey he go komot wit di kidneys.
- Den make Aaron sons burn am for di altar, on top of di burnt offering wey dey for di wood wey dey burn, as offering wey dem make wit faya, sweet scent wey Baba-God like.
- “If di sacrifice of hin peace offering na sheep or goat, make he give male or female wey no get comma for body—to Baba-God.
- If he dey give lamb, make he carry am go Baba-God house.
- Make he lay hin hand for di head of di offering, con kill am for front of di worship-place. Naso Aaron sons go sprinkle di blood round di altar.
- From di peace offering, make he bring sacrifice wey he make to Baba-God wit faya: all di fat, di fat of di big tail wey dem cut near di backbone, plus all di fat wey dey di inside part of di animal,
- di two kidneys wit di fat wey dey near am, near di waist, and di cover of di liver, wey he go komot wit di kidneys.
- Di priest go burn dem for di altar as food, offering wey dem make to Baba-God wit faya.
- “If dis offering na goat, make he carry am go Baba-God house.
- Make he put hin hand for di head, con kill am for front of di worship-place. Naso Aaron sons go sprinkle di blood round di sides of di altar.
- Make he give hin sacrifice, make he give hin offering to Baba-God wit faya: all di fat wey cover di parts wey dey inside plus di fat wey dey inside di animal,
- di two kidneys plus di fat wey dey on dem near di waist, plus di part wey cover di liver wey he go komot wit di kidneys.
- Di priest go burn dem for di altar as food offering wey dem make wit faya, and na sweet scent. Na Baba-God get all di fat.
- Dis na law forever, wey Baba-God don set for una generations wey go come, any where wey una dey stay: una must no chop any fat or any blood.’ ”