Job Chapter 14
Job Tok About Di Wahala of Life
- Man wey woman born go only live for short-time, and hin days burku wit palava.
- He dey come out like flower, and dem go cut am down: he go disappear like shadow, and he no go dey again.
- Abi you dey put your eyes on dat kain pesin, con dey judge me for your front?
- Who fit bring sometin wey clean from wetin no clean? No pesin.
- Hin days get numba, di numba of hin months dey wit you, and hin life no fit cross where you don mark for am.
- Turn komot from am so dat he go fit rest, until he don use all hin time like worker.
- Becos tree get hope sey if dem cut am down—e go grow again, and sey di small branch no go stop to dey grow.
- Even though di root dey old for inside di earth, and di plant go die for inside ground,
- but di scent of water go make am grow, and e go bring branch come out like plant.
- But man dey die and he go just turn to waste. Yes man go kpeme, and where he dey?
- As water take dey dry from big-river, and as stream take dey dry con turn to dry land,
- naso man dey lie down, and he no go rise again, till heavens go pass komot, and di man no go wake up again, or raise from hin sleep.
- I wish sey you fit hide me for inside grave, sey you fit keep me for secret until you vex finish, and you go choose time for me, con remember me!
- If man kpeme, abi he go live again? Den all di days of my hard life nahin I go wait, I go wait until my change go come.
- You go call, and I go ansa you; you go like me wey your hand don make.
- For now, you don count my steps; abi you no dey look my sin?
- Di bad-bad-tins wey I dey do—dey for inside bag wey close, and you dey cover all di wrong tins wey I don do.
- “Surely, as mountains take dey fall yakata to pieces, and as rock take dey move from e place,
- as water take dey chop stones; you don wash komot all di tins wey grow from di dust of di earth; naso you take dey scata di hope of man.
- You dey over-pawa man forever, and he dey pass komot; dia face go change wen dem die, and you go send dem komot.
- He no go know if hin sons grow up to be beta pipo, or if dem be gbanjo pipo.
- But he go feel pain for hin flesh, and hin soul inside am go cry.”