Job Chapter 15
Eliphaz Second Ansa To Job
- Eliphaz di Temanite con ansa sey,
- “Abi wise man go dey tok anyhow? Con full hin belle wit di breeze from di east?
- Abi he go dey reason wit yarnings wey no make sense? Or wit tok wey no dey bring beta tin come?
- You dey make di fear of Baba-God be—like notin, and you dey make praying to Baba-God—be like notin.
- Your mouth dey tok about your sin, and you don choose wayo man tongue.
- You dey condemn yoursef wit your own mouth, and no be me. Yes, na your own lips dey tok bad about yoursef.
- Abi na you be di first man wey dem born? Abi Baba-God make you before he make di hills?
- Abi you don hear Baba-God secret? Abi na only you be wise pesin?
- Abi wetin you know wey we sef no know? Which understanding you get—wey no dey inside us?
- Old men wey get white hair dey for awa side, men wey old pass your papa!
- “Abi if Baba-God cool you down e no dey okay for you? Abi di words too soft for you?
- Wetin carry your mind komot? And why you dey eye us?
- wey you con dey turn your spirit from Baba-God, and allow all dis kain tok dey komot from your mouth?
- Wetin be man wey he go dey clean? Pesin wey woman born—how he go con get clean-heart?
- See, he no put hin trust on hin holy-pipo. Yes—di heavens no clean for hin eyes.
- Tokless of man wey be tufiakwa, wey no clean—and wey dey drink bad-bad-tins like water.
- I go show you, hear me; and I go gist you wetin I don see wit my eyes;
- tins wey wise men tok, tins wey dem hear from dia ancestors and wey dem no hide,
- from those pipo wey di land belong to tey-tey before any foreigner show-face to turn dem komot from Baba-God.
- Na pain dey finish wicked man tru-out hin life, and tru-out hin life wey no sure.
- Bad sound dey ring for hin ears: wen he dey prosper nahin scata-scata go meet am.
- He no get any hope to escape from darkness, and na sword dey wait to kill am.
- He dey travel go abroad becos of food—sey, “Where e dey?” he know sey di day of darkness already near am.
- Worry-worry plus wahala go make am fear, dem go press am down like king wey dey ready to attack.
- Becos he dey stretch hin hand against Baba-God, and he dey give hinsef pawa against di Almighty.
- He dey carry strong shield, and he dey use stubbornness take attack Baba-God.
- Becos he dey cover hin face wit hin fat, and hin waists don turn to ororbor.
- But hin cities go scata, and he go live inside empty houses, wey go soon scata.
- Hin moni no go last, and hin properties no go dey again. Hin properties no go spread for di earth.
- He no go fit escape from darkness; hot faya go burn hin branches, and Baba-God breath go scata dem.
- Make dem no whyne demsef again by trusting useless evil tin, becos na useless evil tins go be he reward.
- He go die before hin time, and hin branches no go ever green again.
- He go be like tree wey dem pluck di fruit wey neva ripe, like olive tree wey e flowers dey komot.
- Becos di pipo wey dey live fake life go scata, and faya go burn di house of bribe.
- Dem dey plan evil, con bring out useless evil tins, and dia belle dey arrange mago-mago.