Job Chapter 18
Bildad: Baba-God Dey Punish Wicked Pipo
- So Bildad di Shuhite con ansa sey,
- “How long before you go stop to tok all dis tins? Try to understand, so dat we go fit tok.
- Why you dey look us like animals, and you reason us as mumu for your eyes?
- You wey dey tear yoursef to pieces as you dey vex. Abi dem go komot from di earth becos of you? Abi di rock go move komot from e place?
- Yes, wicked pipo light go off, and di flash of hin faya no go shine again.
- Di light go turn to darkness for hin house, and di lamp wey dey near am go off.
- Di steps of hin pawa go cut, and hin own plan go fall hin hand.
- Hin own leg go throway am put for net, and he dey waka enta trap.
- Trap go hook am for back of hin leg, and trap go catch am.
- Dem don dig trap for am for ground, and dem don set trap for hin way.
- Gbege go make wicked pipo mind-cut for everi corner, and gbege dey follow everi step wey he waka.
- Hunger to make am no-strong, and scata-scata go dey wait near am.
- Disease dey catch am for body: even di first born of death [bad disease] go chop hin hands and legs.
- Dem go komot am from di security of hin house, and dem go carry am come meet di king of gbege [death].
- Notin wey belong to am remain for inside hin house; brimstone [sulfur wey dey burn] nahin full hin house.
- Hin root go dry kpatakpata for under, and hin branch for up go cut komot.
- Dem no go remember am again for di earth, and he no go get name for street.
- Dem go pursue am from light to darkness, and dem go purse am komot from di world.
- He no go get son or nephew among hin pipo, or anytin wey remain for hin house.
- E shock di pipo wey dey for west becos of wetin happun to am; pipo for di east dey shake.
- Surely, naso di house of wicked pipo go be, and na dis be di destiny of pipo wey no know Baba-God.