Job Chapter 29
Job Blessings Before-before
- But Job kontinu hin yarnings, con tok sey,
- “How I wish sey I fit go back to some months wey don pass, for di days wen Baba-God dey keep me;
- Wen hin candle shine for my head, and wen I use hin light take waka pass darkness;
- Those days wen I dey prosper, and Baba-God show-face for my caban like sey na my padi.
- Wen Baba-God still dey wit me, and wen all my pikin dey around me,
- Wen I wash my steps wit butter, and wen my olive tree grow for even where rocks plenty, and my harvest be like river.
- Wen I komot go di gate di city to sidon wit di senior-men, and I sidon for my position wit dem!
- Di young men see me, and dem hide demsef, and even di old men stand up to show respect.
- Di princes no gree tok and dem put dia hand for dia mouth.
- Di top men just keep quiet, and dem hang dia tongue to show respect.
- Everi pesin wey hear me tok dey bless me, and all eyes wey see me dey tok beta tins about me.
- Becos I epp poor pipo wey dey cry, and I epp pipo wey no get papa and wey no get pipo to support dem.
- I epp those pipo wey no get hope and dem bless me, and I make widow heart dey sing wit happiness.
- Naso I wear goodness, and e cover me like cloth, and I wear justice like gown and crown.
- I con be like eyes for blind pipo, and leg for pipo wey no fit waka.
- I con be papa of poor pipo, and I con dey carry mata wey no concern me.
- I break wicked pipo jaws, and I komot di pipo wey dem wan chop—from dia teeth.
- Naso I con tok sey, ‘Surely I go die wit my family wey surround me, and my days go plenty like sand-sand.’
- I be like tree wey e root dey touch water, and dews wet my branches tru-out di night.
- I dey always get new levels, and I always get new bow (I dey get more-more pawa).
- Men con dey listen to me, and dem dey silent as dem dey wait for me to tok.
- Afta I tok finish, dem no get anytin to add join wetin I tok, becos my words settle dem.
- Dem wait for me as dem take dem wait for rain, and dem open dia mouth wide as if dem dey wait for di last rains.
- I smile for dem wen dem dey low-key; and di light for my happy face—give dem hope.
- Like chief, I tell dem wetin to do; and I live like king for army, and I calm dem down from dia pain.