Psalm Chapter 4
PrayerForEvening
To di music producer. Wit music
instrument wey get string. Dis na Psalm of
David. Ansa me wen I dey call you, chai
Baba-God wey be my good God. You don
cool me from my wahala; sorry-for
me—con hear my prayer.
- Chai man pikin, how long una go dey
turn Baba-God glory to disgrace? How
long una go dey love yeye tins, con dey
follow wetin no be true? - I wan make una know sey Baba-God don
choose faithful pipo for hinsef; Baba-God go
hear me wen I call am. - No do bad tin becos you dey vex; wen
you dey for bed—look inside your heart,
make you dey quite. - Give di correct sacrifices, con trust
Baba-God. - Many pipo dey ask, “Who go fit show us
beta life? Make di light wey dey your
face—shine upon us, oh Baba-God. - You don make my heart brekete
wit jolly-jolly—even pass pipo wey
get full harvest of food, and drinks. - I go lie down sleep wit alafia,
becos na only you dey keep my life safe.