Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 21

Abeg click here to share dis post

Praise For Winning

  1. For di producer of music. Dis na Psalm of David. Oh Baba-God, di king go happy for your strength. And he go happy well-well as you dey save am!
  2. You don give am di wish of hin heart, and you give am everitin wey he ask you.
  3. You welcome am wit beta blessings, and you put crown of pure gold for hin head.
  4. He ask you for life, and you give
    am—long life forever and ever.
  5. He get levels well-well becos you don
  6. save am; you don give am respect and levels—like king.
  7. You don give am blessings wey dey last forever, and you don make body sweet am well-well as he dey around you.
  8. Di king dey trust Baba-God; no- shaking for di king becos di Most High dey sorry-for am.
  9. You go use your hand catch all your enemies; your right hand go fyne all those pipo wey hate you.
  10. You go make dem burn like hot faya wen you dey vex. Baba-God go swallow dem as he dey vex, and hin faya go burn dem finish.
  11. You go scata dia pikin from di earth, you go komot dia pikin- pikin-pikin wey dem neva born from di earth.
  12. Dem plan evil for you, and dem set plan—but dem no-fit succeed, so you go make dem turn dia back, you go set your arrow—con face dem.
  13. Oh Baba-God, rise up your levels as you dey show your pawa; we go sing and praise your pawa.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website