Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 24

Abeg click here to share dis post

Di “King Of Levels”

  1. Dis na Psalm of David. Na Baba-God get di earth, plus everitin wey brekete inside am; di world, plus everi-pesin wey dey stay inside am;
  2. he put di foundation of di earth on top of di big-rivers, and na on top of water he stand di earth gidigbam.
  3. Who fit climb on top of Baba-God hill?
    Who fit stand for hin holy place?
  4. Na pesin wey get clean-hand plus pure heart, pesin wey no dey worship idol, or swear wit wetin no be true.
  5. He go receive blessing from Baba-God, and Baba-God wey save am—go make am dey right.
  6. Dis na Jacob, di generation of those wey dey fyne Baba-God—wey dey fyne hin face.
  7. Raise your head up, oh you gates! Make una rise up, you everlasting doors, so dat di King of levels go enta.
  8. Who be dis King of levels? Baba-God
    wey strong and wey be jagaban, Baba-God wey sabi fight well-well.
  9. Raise your head up, oh you gates; carry dem go up, you everlasting doors, so dat di King of levels go enta.
  1. Who be dis King of levels? Baba-God
    Almighty—nahin be di King of levels.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website