Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 28

Abeg click here to share dis post

Prayer For Epp

  1. Dis na Psalm of David. Na you I dey cry to, Oh Baba-God my Rock; no dey silent tome, or if you dey silent to me, I go be like those pipo wey don go down to di grave.
  2. Hear my prayer as I dey cry to you, as I raise my hand up—dey face your Most Holy Place.
  3. No drag me komot wit badbelle pipo, or wit those pipo wey dey do evil tins, pipo wey dey follow dia neighbour tok wit peace, but dem carry evil for dia heart.
  4. Pay dem back based-on dia works, pay dem based-on di bad tins wey dem don do, pay dem based-on dia handwork—con give dem wetin dem deserve.
  5. Becos dem no gree show respect for Baba-God work, or di workings of hin hand. Baba-God go tear dem down and he no go build dem up again.
  6. Praise Baba-God, becos he don ansa di tin wey I dey ask am.
  7. Na Baba-God be my pawa and protection; my heart trust am and he epp me. So my heart dey happy well-well, and I go praise am wit my music.
  8. Na Baba-God be di strength of hin pipo, na strong-house wey dey save hin pipo wey he anoint.
  9. Save your pipo and bless di pipo wey belong to you; be dia shepherd, and carry dem forever.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website