Psalm (Pidgin Bible)

Psalm Chapter 30

Abeg click here to share dis post

Dis Na Prayer Of Tanks-giving

  1. I go give you levels, Oh Baba-God, na
    you carry me go up, and you no let my
    enemies happy for my mata.
  2. Oh Baba-God my Oga, I call you for epp and you heal me.
  3. Oh Baba-God, you carry my soul komot from grave; you don keep me alive—so dat I no go go down to grave.
  4. Make all hin holy-pipo sing for Baba-God; and give Baba-God tanks wen you remember hin holy name.
  5. Hin vex no dey last pass one second, but hin favour na for life; cry-cry fit burku for night, but jolly-jolly must come for morning.
  6. Inside my prosperity, I tok sey, “No-shaking for me.”
  7. Oh Baba-God, by your favour, you don
    make my mountain stand gidigbam; but my mind cut wen you throway-face komot for my side.
  8. Oh Baba-God, na you I dey cry to; Baba-God na you I dey ask for epp;
  9. “Wetin you gain if I kpeme, wetin you
    gain if I enta grave? Abi dust fit praise you? Abi dust go fit tok about your truth?
  10. Oh Baba-God, hear me, and sorry-for
    me; Oh Baba-God, be my epp.”
  11. You don turn my cry-cry to dance; you
    komot my sackcloth—con wear happiness for my body,
  12. so dat I go sing praise to you, and I no go dey silent. Chai Baba-God my Oga, I go tell you nagode forever.

Loading

Abeg click here to share dis post

Pidgin Bible na did new Bible translation for Pidgin English Language. Di Bible dey easy to read and understand and e get Pidgin dictionary sef, wey go epp pipo understand more.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

No copy from dis website