Psalm Chapter 119
Baba-God Law Aleph
- Blessings for those pipo wey dia way no get error, wey dey waka based-on Baba-God law.
- Blessings for those wey dey keep Baba-God commandment, wey dey fyne am wit all dia heart.
- Dem no dey do wrong tin; dem dey waka for hin way!
- You don command us to keep your law wit seriousness.
- Oh, I wish sey na you dey direct me to
keep your laws! - So shame no go catch me wen I dey
reason all your commandments. - I go praise you wit clean-heart, as I dey learn your good judgements.
- I go obey your law; no fashi me
kpatakpata. - Beth
- How young pesin fit take keep hin way
pure? Na by living hin life based-on your
word. - I dey fyne you wit all my heart; no let me
waka komot from your way. - I don hide your word inside my
heart—sey I no go sin against you. - Blessings for you, oh Baba-God; teach
me your laws. - Wit my lips—I don tok all di laws wey
- you give us from your mouth.
- I don jolly inside di way of your
- yarnings—like pesin wey get moni wellwell.
- I go meditate on your teaching, and I go
- reason your ways.
- Body dey sweet me for your laws; I no go
- fashi your words.
- Gimel
- Do good to your servant, and I go live,
- con obey your word.
- Open my eyes so dat I go see di ogbonge
- tin wey dey inside your teaching.
- I be stranger [jjc] for dis earth; no hide
- your commandments from me.
- My soul really want your judgement
- well-well everi time.
- You change-am-for pipo wey dey feelbig—wey curse dey for dia head, and wey
- dey waka komot from your way.
- No let dem laff me or yab me—becos I
- dey follow your way.
- Even though rulers sidon—con dey badmouth me, your servant go meditate on your
- word.
- Your word dey tortori me; na dem dey
- give me beta advice.
- My soul dey for dust; ginger my life
- based-on your word.PSALMS
- I don tell you about my plans and you
- ansa me; teach me your word.
- Epp me understand di way of your word;
- so dat I go meditate on your ogbonge work.
- My soul don taya for cry-cry; give me
- strength based-on your word.
- Carry lie-lie way komot from my side,
- and give me your law wit grace.
- I don choose di way of truth; I don put
- your word for my front.
- I dey hold your word tight. Chai BabaGod, no let shame catch me.
- I go waka inside di way of your law,
- becos you go open my heart to understand.
- He
- Oh Baba-God, teach me to follow your
- word; and I go follow your word reach di
- end.
- Give me understanding so dat I go keep
- your word; true-true, I go observe am wit my
- whole heart.
- Make me waka inside di way of your
- commandment, na there my happiness dey.Turn my heart go face your word, instead
- of me to get ojukokoro.
- Turn my heart komot from yeye tins, and
- ginger me inside your way.
- Do wetin you promise to your servant
- wey dey fear you seriously.
- Carry di disgrace wey I dey fear komot,
- becos your judgement dey good.
- See as I dey fyne your way! Ginger me
- inside your goodness.
- Waw
- Oh Baba-God, make your mercies come
- meet me, plus your salvation based-on your
- promise;
- so I go fit ansa any-pesin wey dey yab
- me, becos I trust in your word.
- No ever komot di word of truth from my
- mouth, becos I don put my hope inside your
- word.
- I go always obey your word for ever and
- ever.
- I go waka upandan wit freedom, becos I
- dey fyne your way.
- I go tok about your word for front of
- kings, and shame no go catch me.
- Baba-God, I dey happy inside your
- word—wey I love.
- I go carry my hand up to your
- commandment wey I love; and I go meditate
- on your laws.
- Zayin
- Remember your promise to me—your
- servant, wey you don laws.
- make me put hope on.
- Wetin dey cool me down inside my
- suffer-head nahin be dis: your word dey give
- me life.
- Pipo wey dey feel-big dey yab me taya,
- but I no turn komot from your word.
- I remember your laws from olden days,
- oh Baba-God, and dem don cool me down.
- I con dey vex for wicked pipo wellwell—becos dem don fashi your way.
- Your laws nahin be my song any where I
- stay—on di road to my holy destiny.
- Oh Baba-God, I remember your name
- for night, and I keep your law.
- Na dis tin I dey do since: I dey obey your
- commandments.
- Heth
- Oh Baba-God—you be everitin wey I
- want, I don promise to obey your words!I don fyne your face wit all my heart;
- sorry-for me—based-on your promise.
- I reason my ways, and I don turn my leg
- to follow your word.
- I do fast-fast, I no go waste time to obey
- your word.
- Even though badbelle pipo use rope tie
- me, I no go fashi your
- For midnight, I go wake up to give you
- tanks for your good judgements [laws].
- Everi-pesin wey dey fear you na my
- padi, and everi-pesin wey dey follow your
- law na my padi.
- Di earth brekete wit your love, oh BabaGod; teach me your laws.
- Oh Baba-God, you don do good to your
- servant, based-on your word.
- Teach me knowledge and beta
- judgement, becos I trust your commands.
- Before, suffer-suffer hook me, and I
- waka komot from your way, but now I dey
- obey your word.
- You dey good, and you dey do beta tins;
- teach me your laws.
- Even though pipo wey dey feel-big dey
- stain me wit lie, I go keep your law wit all my
- heart.
- Dia heart heavy like ororbor, but your
- law dey make body sweet me.
- E good as suffer-suffer hook me, so dat I
- go fit learn your laws.
- Di laws from your mouth make-sense to
- me pass thousands of gold coins plus silver.
- Yod
- Your hand nahin make me, and nahin
- form me; give me understanding to learn
- your commandments.
- Make those pipo wey dey fear
- you—happy wen dem see me, becos I don
- put my hope inside your word.
- Oh Baba-God, I know sey your laws dey
- right, and you don suffer me inside your
- faithfulness.
- I pray make your kind mercies cool me
- down, just as you don promise your servant.
- Show me your soft-heart so dat I go live,
- becos your law dey make body sweet me.
- Make shame catch pipo wey dey carryshoulder, becos dem do me ojoro for no
- reason; but I go meditate on your law.
- Make those pipo wey dey fear you—turn
- face me, those pipo wey sabi your word.
- Make my heart no get any error for your
- ways, so dat shame no go catch me.
Kaph
- My soul dey faint as I dey fyne your
salvation, but I dey put my hope inside your
word. - My eyes wan close as I dey fyne your
word; I tok sey, “Wen you go cool me
down?” - Even though I don be like bottle for
inside smoke, but I no fashi your law. - How long your servant go dey wait? Wen
you go punish pipo wey
dey show me pepper? - Those pipo wey dey carry shoulder don
dig hole for me-pipo wey no dey follow your
law. - I fit trust all your command; epp me, men
dey show me pepper for no reason. - Dem almost sweep me komot from di
earth, but I neva fashi your laws. - Ginger me based-on your soft- love, so
dat I go obey di law of your mouth.
Lamed - Forever, oh Baba-God, your word dey
settled for heaven. - Your faithfulness dey last for all
generations; you build di earth and e stand
gidigbam. - Your laws don last reach today, everitin
dey serve you. - If to sey no be your laws dey make body
sweet me, I for don kpeme inside my sufferhead. - I no go ever forget your law, na dem you
use take give me life. - Save me, I belong to you, becos I don
fyne your commandment. - Evil pipo dey wait to scata me, but I go
reason your words. - Comma still dey inside everitin wey dey
perfect, but your commands no get full-stop.
Mem - Oh, see as I love your law! I dey reason
am from morning till night. - Tru your words, you dey make me wise
pass my enemies, your words dey wit me
forever. - I get understanding pass all my
teachers—becos I dey reason on your word. - I get more understanding pass di
senior-men, becos I dey obey your laws. - I don komot my leg from everi evil
way—so dat I go obey your word.I neva waka komot from your - laws; yousef don teach me.
- See as your words dey taste sweet,
- e sweet pass honey for my mouth!
- I dey gain understanding from
- your law; so I hate everi wrong way.
- Nun
- Your words na lamp for my leg
- and light for my way.
- I don swear, con confam sey—I go
- follow your good laws.
- I don suffer well-well; keep my
- life, Oh Baba-God— based-on your word.
- Oh Baba-God, biko, accept di
- offering of praise wey dey come from my
- belle, and teach me your laws.
- Even though my life always dey in
- danger, but I no go fashi your law.
- Wicked pipo don set trap for me,
- but I neva waka komot from your ways.
- I don inherit your laws forever; na
- dem dey give my heart joy.
- I don make up my mind to keep
- your laws forever to di end.
- I hate pipo wey get two-mind, but
- I love your law.
- Na you I dey hide my head put,
- and na you dey guard me; I dey put my hope
- on your word.
- Badbelle pipo, oya komot for
- where I dey, becos I go keep Baba-God law!
- Keep me as you don promise and I
- go live; no let shame catch me becos of my
- hope.
- Carry me up, and I go dey saved;
- and I go always respect your laws.
- You don fashi all those pipo wey
- waka komot from your way, dia wuru-wuru
- na fake.
- You don fashi all di wicked pipo
- for di earth like yama-yama, so I love your
- laws.
- My body dey shake becos I dey
- f e a r y o u ; a n d I d e y f e a r y o u r
- judgements.PSALMS
- I don do justice and goodness, no
- leave me wit pipo wey dey oppress me.
- Make sure sey your servant dey
- alright; no let pipo wey dey make-mouth
- oppress me.
- My eyes don dey pain me as I dey
- fyne your salvation, as I dey fyne your
- correct word.
- Run tins wit your servant based
on how you dey sorry-for pesin, and teach
me your laws.
- I be your servant, give me
understanding so dat I go sabi your words. - Oh Baba-God, e don reach time
wey you go do sometin; becos dem dey
break your laws. - True-true, I love your command
pass gold—eehn, pass pure gold. - So I reason sey all your laws about
everitin dey right for me to follow, I hate
everi wrong way.
Pe - Your words dey make me wonder;
so my soul dey obey dem. - As your word dey enta—e dey
show light; e dey make ordinary pipo sabi
understand. - I open my mouth dey breath- fastfast, becos I dey fyne your word.
- Turn face my side, con sorry-for
me, as you dey do to pipo wey love your
name. - Direct my leg based-on your
word; no let sin control my life. - Save me from di oppression of
man, so dat I go obey your word. - Make your face shine for your
servant body, and teach me your laws. - Water dey rush down from my
eyes like river, becos pipo no dey obey your
law.
Tsadde - Oh Baba-God, you dey good, and
your judgements dey right. - Di laws wey you don put down na
correct law; and dem faithful wella. - I don taya to dey burn like faya,
becos my enemies don fashi your word. - Your word pure wella, so your
servant love dem. - Even though my level low, and
pipo hate me, I no forget your teaching. - Your goodness dey last forever,
and your word na true. - Wahala and serious pain don cover
my head, but na your laws dey tortori me. - Your words dey correct forever;
give me understanding so dat I go live.
Qoph - I dey call wit all my heart; ansa
me, oh Baba-God, and I go obey your laws. - I dey cry to you, save me and I go
- keep your word.
- I wake up before morning reach,
- and I dey cry for epp; I dey put my hope on
- your word.
- My eyes dey open tru-out di night,
- so dat I fit reason your promises.
- Hear my voice based-on your softlove; oh Baba-God, ginger my life based-on
- your justice.
- Those pipo wey dey plan wicked
- tins don dey near me; but dem dey far from
- your law.
- But you dey near, oh Baba-God,
- and all your laws na real.
- E don tey wey I don know sey you
- don stand your word to last forever.
- Resh
- Look my suffer-suffer and make
- you free me, becos I neva fashi your law.
- Fight for me and save me; keep my
- life based-on your promise.
- Salvation dey far from wicked
- pipo, becos dem no gree fyne your laws.
- Oh Baba-God, your soft mercy
- burku wella; ginger my life based-on your
- judgement.
- Plenty pipo dey show me pepper
- and my enemies burku, but I no turn komot
- from your word.
- Yeye dey smell as I dey look evil
- pipo, becos dem no gree obey your word.
- See as I love your word; oh BabaGod ginger my life based-on your love.
- All your words na true; and all
- your good laws dey last forever.
- Sin and Shin
- Pipo wey get pawa dey show me
- pepper for no reason, but my heart dey
- wonder for your word.
- I dey happy for your word, like
- pesin wey see beta-beta-tins.
- I hate, and I no like lie-lie, but I
- love your word.
- I dey praise you seven times a
- day—becos of your correct judgement.
- . Pipo wey love your
- word—get peace well-well, and notin fit
- make dem stagger.
- Oh Baba-God, I dey wait for your
- salvation, and I dey do wetin you tell me to
- do.
- My soul dey keep your word, and I
love dem wella.
- I dey obey your teachings, plus
your word—and you sabi all my ways.
Tau - Oh Baba-God, listen to my cry;
give me understanding based- on your word. - Listen to wetin I dey ask for; free
me—based-on your word. - Make my lips pour wit praise,
becos you dey teach me your laws. - My tongue go tok about your
word, becos everitin wey you tell me to
do—na di right tin. - Use your hand take epp me, becos
I don choose your teachings. - Oh Baba-God, I dey wish for your
salvation, and your law dey tortori me. - Make my soul live, and I go praise
you, and make your word epp me. - I don miss-road like sheep wey
lose. Fyne your servant becos I no dey fashi
your commands.